Na one die man go die by Adewale Sobowale

A hear say de oga patapata for obodo Amerika surgeon don tok say maya dey cause cancer. 

De tin dey do me one kin. you sabi say if man get cancer, na kpai be dat. But a com get consolation say na sometin go kill man. even if na person money e take bay’am.

De oda tijn be say a no dey take lager or ororo again. No be say I no dey do maya o. I don graduate to wine. But den dey tok say all maya dey bad. 

Na wah o, e pass wah sef, na wah wah wah.

Wetin dey pain me be say de book wey dem de read for shursh talk say make we drink small maya for awa illness. You know say small dey different as people different. Wetin small for me fit big for anoda.

I don study dis country very well. de tin be say dem no dey take maya play. Especially for inside snow, na harmattan go speak for person wey dey inside underwear.

Anoda tin be say, de idea of stopping maya no go sweet de bele of people wey dey sell am, drink am, and even de gofment of many country. Fact different from fanta, de tin fit cause economic kwashiorkor. Tink of de people wey dey chop from inside maya either directly or indirectly.

De tin be say for many poor people, especially for Naija, as ordinary man no fit buy beer, dem don dey put different concussion for plastic wey dem dey call bitter. If you hear bitter, make you sabi say na maya.

A beg make you helep me beg oga surgeon-general make dem go do research comot de cancer wey de inside maya. 

Until den, na one die man go die!

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *