Wetin you dey find for Sokoto? by Adewale Sobowale

Photo credit: the Sum

Wetin you dey go look for in Sokoto when de tin you dey find dey inside ya sokoto?

Gofment of Nigeria don announce say de foreign reserve of de contiri don reach 41 trillion dollar. Dat one na treedaful news. Especially as den tak say de money na highest since 2021. Even de GDP don dey 187.8 billion dollar. Dat one na anoda good news/

But wetin concern me be say e never reach de poor man, I mean de citizen Mudas of Nigeria..

Even, de tin no too affect foreign exchange. Fuel sef, don reach sky.

But wetin I dey beg for na make gofment and private people put money for agriculture.

If we put money for agriculture, de farmer go chop. As im no fit chop everytin, im go sell for other people.

As e be now, Nigeria dey state of starvation, na only de rich dey enjoy! 

I don tak am before, and I go tak am again. Na only farm estates fit solve Nigeria problem.

Na only then, we fit dey build all dis fancy projects!

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *