Open Letter To Fela – Adewale Sobowale

Kalakuta Annex,
Heavenly Kingdom.

Kalakuta Republic,
Idi Oro,
Nigeria.

Eleniyan,
How you dey? Se all de Lady dey ok. I mean your queenly queens. I sure say you no be Gentleman for heaven.

In your last letter, you talk say Expensive Shit dey worry you. Maybe na because of the Water No Get Enemy wey you take.

Wetin go happen be say, if you do Expensive Shit, the Confusion wey dey cause Sorrow Tears And Blood go comot.

Se I tell you say that Mr Follow Follow wey nak you for jail be our president now. I mean that Unknown Soldier. E don do Kalakuta Show for us so tay we dey Hear Wen.

International Thief Thief boku for im government. We dey still battle for Water, Light, Food, House. Na so o.

Yeparipa!

We dey do Roforofo Fight for de government. But you know say na de Zombie mentality we dey. Me I wan dey do Gentleman o, de reason be say e be like say na Stalemate we dey upon all our Shuffering And Shmiling.

But I dey do Na Poi when I get the Ikoyi Blindness woman. You remember am? That Lady wey im papa com give you Roforofo Fight before you com get Sorrow, Tears And Blood.

You don forget? That one wey land you in Alagbon.

You say na you be choir master for heaven. Se Baba God dey gree you take African Natural Grass. Anyway, I trust you. Even if dem no gree, man must find im way.
I know say you go dey give Baba heavy African vibes with your gbedu!
A just wan halla you say happy birthday. I go talk say make Brother Koye wife prepare moin moin come for you. I no say you dey like am well well.

Greet our authentic African brothers there. How Beko, Gani, and Koye. Se you don’t settle your Roforofo Fight with Abiola?

Salute them with a powerful Blackman salute.

Yeah, yeah!
Adewale

101517

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *