If we take donkey’s years to craze, na how long we go take do de craze not to talk of when we go take find person wey go cure our craze?
Na dat saying go fit de Nigeria people wey dey South Africa.
De illegal group wey call themselves, March and March, don announce say make all illegal migrants comot dem contiri by June 30. E be like say the mob don become immigration.
E true say the Government of South Africa don talk say na lie March and March dey talk. Den talk say den go put police, army and other security people for alert. Even if dem put security everywhere, na dem go live with dem?
Dem say Nigeria people wey de South Africa without papers reach 500,000. Government don evacuate less than 400. Wetin I hear be say over 1,000 Nigeria people remain for South Africa as den no get transport money.
If to say government no promise dem, dem go, no say na OYO dem dey. But government don promise dem and dem talk say promise na debt.
Wetin I dey talk be say if Aso Rock no go carry dem quick quick, dem go be sara for dose people.
Dem talk say na begi we go begi woman wey get winch, make iim no take child doo contribution, das why I dey beg de Nigerian government.


