Winter no easy! by Adewale Sobowale
I like Canada die. But I no like winter. Oyinbo fit call de two statement oxymoron as Canada and cold winter be akamu and akamu water. To top the winter, e get one wey dem dey call snowstorm. Dat one be like heaven open for snow. De snow go come down reach trouser-length for person. …

