Naira don dey rise against dollar!

Photo credit: the Punch

Ground no level for the people wey dey sell dollar as the naira don rise like aeroplane on the EFEM market. 

Nairametrics yarn say the naira close for 1,535 against one dollar on Friday, December 6, 2024.

Dis na good tin because as naira don dey rise more after three days since Central Bank of Nigeria don introduce the Enhanced Foreign Exchange Market Sysrem (EFEMS).

Black market rate don fall yakata so tay e don reach 1,570 naira to one dollar. The people wey dey sell say yawa don gas as sellers dey do kurukere to find people wey go buy market.

E reach point wey no one wan buy from dem. Even some of the sellers say dem reduce the price to 1,500 naira for one dollar. 

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *