Na election be dat? – Adewale Sobowale

Photo credit: Aljazeera

Ontario say dem do election yesterday!

Na time like dis I dey miss my kontiri.

Haba!

So, dem talk say dem do election and dem no spend money.

Even sef, de day wowo pass ordinary.

Yes…

Money no go round, money for de boys, money for de women, money for de godfada.

Na wao!

If to say dem spend money for de agbero, dem go take am buy weed and f’enu ja and everybody go dey selenkejo. People no go no say winter dey.

Dem even fit carry ballot box. Abi make dem stuff de box with votes of people wey no dey.

For dis place, lawyer no fit get money. I talk am because everybody don gree for the result of election. Dem no go court. Judge sef no fit make money.

So, how money go go round?

I don see say Afrika, especially Nigeria, fit export somtin. We fit teach western world how to do election.

We go dey call am Electoconomy as a side hustle of political economy.

Dat na how money dey go round for election!

And believe me, some people dey survive inside election. If election no dey, dem no fit dey inside life.

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *