Who tak say Nigerians hungry?

Umaru Dikko wey be Transport Minister for Sheu Shagari go dey laugh and fall yakata where e dey now as im prediction for Nigeria don come true.

No be him talk say Nigerians go dey eat from dustbin because of hunger?

Sebi na one paper like dat say Nigerians dey hungry. Dat paper must be banned for nacking nail for head by saying the koko point.

Na im the presidency com defend say de situation no dey so bad at all. Na so, now!

Se government people dey buy from .local market. Even if den buy, good cost no be dem wahala. 

Money dey talk!

So, wetin concern government with every citizen Muda? Wetin concern agbero with overload

I don talk am before say de people don sell dem birthright for a mess of pottage. So, dem must wait for next election before dem get atomach infrastcure.

Because why?

Many people don collect money for stomach infrastructure before election. Those wey no collect dey stand look like Lukeman as injustice dey go on for dem front. Dem no talk because of fear. 

Na im make us dey where we dey so.

How much be CFA to Naira some years ago. How much e be now?

How much  be dollar, pound and other foreign currencies to Naira before? How much be the rate today?

I don talk am before say projects like roads, airports, and so on dey desirable but not essential for Nigeria as e dey now. My people talk am say na cloth wey suit time, person dey wear for time. I for prefer make governments and local investors go invest for mechanised agriculture. If we fit do dat, people go dey chop and den go dey get money for dem pocket..

We get youths wey go school and dey look for office job wey no dey. If dem get short training for agriculture, food go cheap. Cash crop like cocoa sef dey there. If we wake up and cultivate dem and add value to dem, money go come. 

De tin wey government fit do for youth be say make dem start farm estate for dem. Dem go com put all de fine fine ting wey dem dey look for in de city for de estate. Tins like accommodation, light, water, internet facility, club house, and school. Dem fit give de farmers credit facility and tar de road wey go de farm estate.

If we do dis, food go boku. Make government organise food banks and give money to people wey  no get work.

E be like say government dey use hunger as a weapon to punish people. If dem make country good, dem no go get people to use as foot soldier for election wotowoto.

Wetin Nigeria dey face pass hunger, na starvation epidemic!

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *