Pikin never waka,
E yarn say,
Im papa farm,
Na im reach pass.
Wen e don waka
Reach, e come sabi,
Say de people
Wey dey rule us.
Dem be baba nla,
For lie lie.
Wetin dem dey
Do sef?
Na baba nla,
For jibiti
Plus Wayo.
Cunny man die,
Wayo man
Bury am-
Two jam four.
Dem dey collect
Big big money.
Dem dey use am,
Do Ajala travel.
Upon wetin?
Dem dey do
Yanfu yanfu
For dem family.
Dem come back
Come give us
Crumbs wey fall
From dem table.
We dey chop am.
Person wey never
Chop for ogbonge
Years, no chop reach!
Na de tin
We dey chop
No make
Us wise.
We no dey reject,
Re ginni?
Na so so
Chop chop
We dey.
Hosipita? E no dey!
Water? E no dey!
We dey kule with
I better pass
My neighbour.
E get as e be,
E be as e get.
We siddon dey look
Like lookozade.
Na Armageddon
We dey await.
Baba God don
Try for us.
Na we be
Suegbe pako!
@ as 051418


