I hail una o!
You know say I no kuku go sukuru but I sabi some sense.
De tin wey dey worry us, I mean we Naija people, na wetin people wey go sukuru dey call White Knight Syndrome or Saviour Complex.
Sa, di tin be say we go dey wait for person make dem come give us solution to awa problem at di expense of dem own enjoyment.
But di tin be say, nobody go fit solve awa problem if we no sit tight and solve awa own problem.
Tufiakwa!
Even people wey we trust, dem be like when you give craze man hoe, no be im self e go first direct farm produce? Na so e be for dem.
You don see am say di people wey we dey trust understand awa situation. Dem know say we get low self esteem or childhood experiences we wowo.
Na im den dey use against us.
I don dey talk am say if we no call meeting of people wey dey suffer, we go dey tink say na enjoyment we dey.
Our case com be like snake as den no dey togeda and human being dey chop dem one by one. If dem walk together, make adder, anaconda, cobra, python, and boa all dey walk togeda, who born man pikin make dem go near dem?
The Yoruba own na im dey worse. Dem go say na kule go win di race. But all dis yeye people no sabi kule.
A no say make people no take stomach infrastructure o. Afterall, na awa money wey dem don keep dem dey use, wey Yoruba dey call na Abu money dem dey use entertain Abu.
But I want make people stand as one against dis yeye government. If dem allow demokracy, but if den no allow we go know say we don try.
A beg make nobody go die for dia war o!
031726


