No awoof bus for people wey japa again!

“Awoof dey run bele,” na saying for Obodo Naija.

BBC report say people say people wey japa to Wales wey be one of the tiri kontiri wey make Great Britain no get awoof for bus again. Dem tok say an de gofment of Wales cancel am.

Welcome Ticket wey de gofment start in March 2022 don dey helep for people wey japa from Ukraine, Afghanistan, Hong Kong, and others.

De Awoof go end on March 31. But gofment say dem go replace am with anoda one in future.

One man wey japa from Sierra Leone, Marius Ambara Kamma tok say, na shame to withdraw the awoof as many people no fit get money to waka. Im tok say im use de ticket wen e first reach Wales with korofo pocket.

Kiran Lochhead Strang wey dey work for Cardiff’s Oasic centre, where den dey give support to people wey japa tok say, if de awoof no dey again, e go stop people wey wan mix with society. Im sef tok say na shame e be.

De gofment tok say for de two years wey de awoof don last, about one million journeys na people make with de awoof.

But sha, de gofment say dey konsider a beta one in the future.

A tokwoman on social justice, Sioned Williams tok say stopping de awoof, even for short period no good at all, at all.

E tok say action beta pass words. Say if de gofmemt say de nation na where people wey japa fit come, dem musto give all de necessary tins wey support dat idea.

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *