De world bodi, united Nations Organisation, don tok say about 55 million people dey face hunger for West and Central Afrika.
Dem tok say de people go go hunger from June reach August this year. Na de Permanent Inter-State Committee for Drought Control in the Sahel na im report de news.
De number de four-million pass de people wey dem forecast for November 2023. E com increase by four in five years. De number dey skata skata people because of conflict wey dey northern Mali, where people wey go reach 2,600 fit go hungry. Information don show say many other factors don come wey dey bring insecurity wey no be because of de conflicts.
Challenge for economy like dollar wey don cost, price of goods wey don reach roof, factory and farms wey don stop production, and trade barriers na dem combine to make de food problem worse. De tin wey dey pain pass say na de ordinary people wey dey Nigeria, Ghana, Sierra Leone, and Mali be de ones wey bad pass.
De price of grains dey go up throughout de region. E dey rise from 10 % reach more than 100 % when compared to de last five years. De tin wey dey cause am na currency inflation, oyel, moto cost, ECOWAS law, and law on agricultural and meat products.
West and Central Africa be major importers of food items. As import dey rise because dem local currency dey go down and price of tins dey go up, de kountries sef dey battle with major money and economic problems.
Cereal production for 2023-2024 agricultural season show say e reduce with 12 million tons.
WFP’s Acting Regional Director for Western Africa, Margot Vandervelden tok say na dis be de time to act. Im say dem need all partners make dem follow up with plans wey go stop de situation from going worse.
Food don increase, healthcare no reach, and as people no reach good food dey cause malnutrition for de children wey dey under 5 years, school children, and women wey dey pregnant. In some parts of Northern Nigeria, women of age 15 to 49 years wey no dey eat good food don reach 31%.


