Winter no easy! by Adewale Sobowale

I like Canada die. But I no like winter.

Oyinbo fit call de two statement oxymoron as Canada and cold winter be akamu and akamu water. To top the winter, e get one wey dem dey call snowstorm. Dat one be like heaven open for snow. De snow go come down reach trouser-length for person.  Dat one even better if e no reach person waist.

When de people wey dey here come awa kontiri, we dey tink say na style dem dey do if den put hand for poket. Na lie o. Na because den don use to dey put hand for poket inside cold. 

Before I com, I dey drink plenty coffee. But when I reach, I com know say my plenty no dey enough. 

Wen den tok say make you dress warm, no take am say dem dey play o. If you no do as dem tok, na im be na OYO you dey. De cold go hammer you pass Hammersmith.

For many of us, we dey wear clot for layer. Na im be say we go wear like four or five clot.

One tin wey dey interest me be say some people go dey play inside de snow. dat one na sometin wey I neva sabi. Even work no dey gree me go for winter. E go dey do me laik sleep laik sleep.

But person no get choice. If I no work, where I go see money?

Canada na wah! 

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *