Pidgin
Dis cold go pass! – Adewale Sobowale
As I don dey Naija for all my youth, one tin I never dey use to na winter. When e come, I just dey pity masef. I dey pity masef sake I no dey like deck masef with winter clothes. And if son of man no dress warm, na frostbite person dey look for. When winter…
God na Baba – Adewale Sobowale
God dey wonderful abi na tenderful! I tok so because de Ramadan and Lent com overlap each other dis year. And yet, people wey dey do bad go say dem be Christian or Muslim. Dem fit be any other religion sef or abi free tinker. De koko of de mata be wether dem be good or bad…
Na election be dat? – Adewale Sobowale
Photo credit: Aljazeera Ontario say dem do election yesterday! Na time like dis I dey miss my kontiri. Haba! So, dem talk say dem do election and dem no spend money. Even sef, de day wowo pass ordinary. Yes… Money no go round, money for de boys, money for de women, money for de godfada….
Winter no easy! by Adewale Sobowale
I like Canada die. But I no like winter. Oyinbo fit call de two statement oxymoron as Canada and cold winter be akamu and akamu water. To top the winter, e get one wey dem dey call snowstorm. Dat one be like heaven open for snow. De snow go come down reach trouser-length for person. …
I nefa see dis kain tin before – Adewale Sobowale
Photo credit: pay prop As I wan comot for house dis morning go do work and chop, I go check my mailbox. I com see one envelope inside. I no take am becos why? Na from ministry of finance e com. As I no sabi wetin dey inside, fear com grip me so tay I…
Se na laik dis we go dey go for Naija!
Photo credit: AP News E get one tin wey dey pain me pass and I go tell readers today. De last time I check, one of de duties of gofment na to protect Naija people wherever dem dey. Amerika oga presido Donald Trump don tok say im go deport plenty Naija people and Naija gofment…
Na one die man go die by Adewale Sobowale
A hear say de oga patapata for obodo Amerika surgeon don tok say maya dey cause cancer. De tin dey do me one kin. you sabi say if man get cancer, na kpai be dat. But a com get consolation say na sometin go kill man. even if na person money e take bay’am. De…


