Photo credit: Arise News
A leta to Fela!!
Dear Baba 70,
I wan jollifficate with you on your eightieth birthday.
You know say all de tins wey you sing about still dey happen for Nigeria, even Africa.
Dem com dey yarn say you be prophet. Dem no know say na angel you be.
Sebi dem tell you say na de man wey land you for jail be presido. Dat man na proper suegbe pako.
Im tink say soja sense go fit rule Naija. Dem com dey steal money under am. Im sef, put im shildren and family for position of authority.
Na real Authority Stealing!
Nigeria no come get head not to talk of tail. Confusion com break bone. De situation wowo pass Ojuelegba.
Sebi you don hear say dat your country man wey supervise de burning of your house and killing of your mama na im dey decide who go rule.
But e be like say you don swear for am. Nobody wey im put there don do well. E be like say de man sef no sabi imsef. E jus wan remain relevant.
But only a few people still dey authentic. People like your cousin, Kongi. E be like say your lawyer Femi don tire for Nigeria matter.
Now be de time wey dat your party, Movement of De People for get chance. But hunger don mama the poor man in Nigeria say dem no fit discover demsef.
Dem just dey fall for anytin. E get one election wey dem dey line up for 250 naira.
But today no be talk talk day. Na to wish you happy birthday. I know say your brother Professor wife go prepare your favourite food, moin moin for you. You go com top am with heavenly wine.
Dem get grass for heaven? If not dat na biz for Naija people o!
Happy birthday, Baba!
101518