Pidgin
Kenya dey boil o!
Photo credit: channels Kill and go don wear de same torosa with people wey no gree for de tax wey de gofment of Kenya put. De fight wowo for de capital, Nairobi as demonstrators don waka full contri, Dem no leave de president home town wey be Eldoret. De kill and go plus including dose wey dey…
Who no know go know!
Photo credit: Vanguard A dey greet all de traders, artisans, farmers and all those wey no dey salary class. Na da one we dey call, no work no chop. De reason I salute dem be say dem just sit down jeje dey look like lukuzade as organized labour dey bargain. Dem don know say an…
University for Obodo don stop Nigerian students!
Photo credit: Pulse Nigeria Teesside University wey dey United Kingdom don send some Nigerian students out as dem say make dem comot for dem country. No be say na theif dem thief but na money mata. De student tok say devaluation of the naira na im cause de palava. Dem tok say de mata wey…
The Gift – Adewale Sobowale
Photo credit: Story blocks Was going somewhereJust like everyoneCame across himSaid I,Good morningAnswered he,Good morning! We started conversingHe pointed out the factHe doesn’t like thoseWho don’t greet! I agreed with himAlso told him it’s the reasonFor loneliness and depressionExperienced by many in the West! Remembering my AfricaIf you’re not seen any dayIt’s sure you’ll receiveMany…
Minister don petition IG sake of marriage plan!
Photo credit: Voice of Nigeria De oga madam wey be Minister of Women Affairs in Nigeria, Mrs Uju Kennedy-Ohaneye don write petition to de oga patapata of police, Kayode Egbetokun. No be dat alone o, e don ask for court injunction. De koko of de mata be say de speaker of Niger State House of…
My People! – Adewale Sobowale
Pikin never waka,E yarn say,Im papa farm,Na im reach pass. Wen e don wakaReach, e come sabi,Say de peopleWey dey rule us. Dem be baba nla,For lie lie.Wetin dem deyDo sef?Na baba nla,For jibitiPlus Wayo. Cunny man die,Wayo manBury am-Two jam four. Dem dey collectBig big money.Dem dey use am,Do Ajala travel. Upon wetin?Dem dey…
Ododo don achieve!
I no understand why Nigerians dey yan say governor Usman Ododo of Kogi Siaie no tok well as e don broadcast im achievement for 100 days in office. Maybe dem no sabi wetin im name mean for Yoruba. Ododo for Yoruba mean truth and e fit mean flower too. As im name be na im him…


