Who no know go know!

Photo credit: Vanguard

A dey greet all de traders, artisans, farmers and all those wey no dey salary class. Na da one we dey call, no work no chop.

De reason I salute dem be say dem just sit down jeje dey look like lukuzade as organized labour dey bargain. Dem don know say an dem go laugh last.

Why?

Even if gofment fix one million as minimum wage, no be market dem go spend am? Dat na where de traders dey wait for dem to grab dere abunna.

When I look all de wahala wey dem labour dey do, a just dey laugh.

E be like say dem never sabi anytin.

Wetin I tink say go make Nigerian economy beta na to first go back to de farm. Na dere we get comparative advantage. Comparative advantage be ability to produce a good or service for lower opportunity cost than our trading partners. As we get land wey fine for agriculture and weather wey fine pass, wet in remain?

See, wetin dat one mean be say make gofment and even private investors build agricultural estates in all local governments. Make dem make roads from farm to city go beta. Make dem com put machine wey go dey preserve de crop for farm because de farm produce wey dey spoil before dem reach market plenty pass de one wey dey go market. I dey talk of tings like silos. Of course, light must dey dere and every odd place.

De second tin be say make dem reduce de cost wey dem dey spend for government. Make dem first star with people wey dey make laws. Dem salary and other benefits don too much. E go even beta make dem reduce am to one house.

De oda one be say make dem reduce de money wey dem dey spend on de executive.

Make we dey tink about giving all de states resource control. dat one be say an each state go det control I’m resources. If we do data, governors no go dey go Abuja before dem get money. Anoda advantage be sat each state go fit fix I’m salary.

Den gofment must stop all de jaqgbajantis wey people dey import or put very high tariff on dem.

Make gofment ban all projects wey dem dey do to attract foreign investors. Ge sad truth be say no foreign investor go come where dem fit kill am. All states wey dey do tourism should stop dat unless na for Nigerian tourists. Make we first work on our security so dat we go fit dey sleep well. Na when we Sabi sleep with both eyes closed we fit dey call foreigners.

Na these and more fit rescue Nigeria.

One thought on “Who no know go know!

  1. No short cut to climb a palmtree,if we refuse to do the needful we’ll just be moving in circles like we’ve been doing all these years🙄🙄🙄🙄

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *