Photo credit: Pulse Nigeria
Teesside University wey dey United Kingdom don send some Nigerian students out as dem say make dem comot for dem country.
No be say na theif dem thief but na money mata. De student tok say devaluation of the naira na im cause de palava. Dem tok say de mata wey don reach say dem no get money pay dem school fees and e make dem go against dem visa condition.
Dem tok say de school don block some of dem from class and dem report dem to Home Office. Dem don even ask some of dem to go back home.
Di University sef kala say na condition make crayfish bend.
Bit the students tok say de University dey heartless as dem no provide dem concrete support.
De students wey be 60 in number dey beg de University make e temper justice with mercy.