Photo credit: Mitrade
I dey beg all awa paito for Africa, especially Naija, say make dem no vex. De reason wey I dey beg dem be say, one tin escape my mind.
And dat tin go help dia ministry wella. But for de Naija paito, I know say my apology no necessary as Naija no dey carry last.
But na dose wey sabi o. I know say awa paito sabi well well.
Di tin be de tariff wey president of Obodo America dey use like chin gum on various countries and dose wey get blood dey return am.
Na de age of tariff we dey!
I come tink am say e go good make awa paito dey use tariff as prayer point. You know say awa people be mumu. You fit helep dem mumuness if you add tariff as a prayer point.
Even, if we look am well well, you no go need any oda prayer point apart from tariff.
You fit start with Baba God wey no collect money before e give us life. Im no collect money before e give us gari chop. Im no collect money before e give us shindren. Even e no collect money before e allow us commit sin.
A beegi make we tank am
If you never introduce de prayer point, tink of how much you go get wen you introduce am.
You go tank me later especially as I no dey collect sisi