Russia don put Zelenskyy on wanted list!

As de war wey dey between Russia and Ukraine dey drag like okro and pesin no know when e go end, Russia don declare Oga Presido for Ukraine, Volodymyr Zedlenskyy, say na wanted pesin.

Dis declaration get why.

De tin be say De President of Russia, Vladimir Putin tink say de war go be small tin wey no fit las one month. But for where? De war wey start for February 24, 2022 don nearly reach fifteen months.

E come be like say, Putin don dey frustrate and desperate.

Russia soja don try yamutu Zelenskyy  since de war start, but de man chi dey strong. 

Ukraine foreign ministry come talk say na attention Russia dey find as dem don try and den no fit win de war. 

Meenwaila, International Criminal Court don issue arrest warrant for Putin head. De warrant be for war charges and dey fit work for 123 kontiri.

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *