Ododo don achieve!

I no understand why Nigerians dey yan say governor  Usman Ododo of Kogi Siaie no tok well as e don broadcast im achievement for 100 days in office.

Maybe dem no sabi wetin im name mean for Yoruba. Ododo for Yoruba mean truth and e fit mean flower too. As im name be na im him behavior be. Im dey tok true.

Wetin my people want make im do again?

Im no meet National Security Adviser?

Im no go meet im fellow Progressive governors?

Im no meet Minister of Agriculture?

Im no clear land for farming abi im no do census for farmers?

De tin wey dey worry me be say im no put say im collect salary. Se im do im duty for de ozza room?

All de tin wey im say im achieve no reach wetin a councilor do, if the country beta.

But as im no fit lie, na im make am tok true!

Make I tok my own true, I see de tin as kindergartenish!!

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *