My bele dey sweet!

Na so o!

Mai bele dey sweet wella.

Bikaus why?

No be bekaus I chop okporoko and okro with mai gari. No be bekaus I com use tombo top am.

I no chop lottery or even baba’jebu.

Na jeje I sit don con luk’am for YouTube and I come see say one organization wey dem dey call Adela Azeez Community Care Foundation go train 150 women for agriculture business. Abeg, I troway salute for de people wey dey dat organization. 

You know say Yoruba people tok say, na de way to throat be de way to heaven. Den even tok say, if hunger comot from poverty, poverty don finish. 

Make we imagine say each state in Nigeria train 1000 farmers. Den come make estate for dem. For de estate, dem com build apartment for each farmer, dem put internet facilities, dem put klub, dem bulid skul, dem make road, dem com dey give de farmers loan.

Wetin go happen?

Even dose wey go skul and dey parade city yet den no get work go go bak to farm.

I tink say hunger no go dey for Nigeria again!

Dat’s why I write am before say all tok say den wan start Nigeria Airways and Ajaokuta Steel Mills again dey good but not important for now. Make cost of food come down fes. 

When people beleful, na im all dose big plans go sweet!

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *