Photo credit: Voice of Nigeria
De oga madam wey be Minister of Women Affairs in Nigeria, Mrs Uju Kennedy-Ohaneye don write petition to de oga patapata of police, Kayode Egbetokun. No be dat alone o, e don ask for court injunction.
De koko of de mata be say de speaker of Niger State House of Assembly say e wan find husband for 100 girls wey dem parents don die.
De speaker tok say as de girls don lose dia parents because of bandit attack, e beta make im do dem “favour” by finding husband for dem as part of im constituency project.
Im tok say na pity im pity de girls suffer-suffer. E even say e go pay dia dowry and buy materials for de marriage.
But de minister say na fa, fa, foul. Im tok say dem don start full investigate for de case.
De minister throw spit up com use face catch am as im say im and de government no gree. Im tok say de plan no follow Child’s Rights Act. E also tok say de children future and even de children wey dem go born must get plan.
E come tok one koko point say de speaker no tink of empowering de children or sending dem go skul or even giving dem some kind of training.
E also tok say de ministry don decide to carry de mata for head and educate de children. Dose wey no wan go skul, de ministry go send dem go learn trade and empower dem.
E con warn de speaker say if im try do de opposite of wetin im tok, gbege go happen because na court im go find imsef.
E finish de tok say every child na gofment pikin under Child Rights Act. So, all children go fit get protection from harm, violence or anything wey fit scatter dia right.


