Makoko community!

So, we don get dirty Lagos last December!

People wey get money dey enjoy inside one of de dirtiest of Lagoses in places like Ajah, Victoria Island, Ikoyi, Banana Island, Orange Island, and so on.

A beg, de real dirty Lagos dey places like Makoko and Ajegunle.

How people go dey live for dese terrible conditions without potable water, washrooms, and den dey pay tax? Even if den no dey pay, dat one disqualify dem from human dignity?

Abi den no be humans?

I tink de gofment must be very insensitive to de people’s plight. 

I no tok say slum no dey for oda kontiri, but wetin de gofment of dose kontri dey do? Wetin awa own gofment dey do?

I beg, who go save Makoko?

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *