Tins don cost well, well.
As if dat wan no do, plenty katakata com dey awa world.
Na im I com dey tink am say e for beta make man run comot from dis world. No be say pesin go kpai. I com dey tink say sebi no be only Earth dey.
E get some place wey dem dey call exoplanets. Some of dem be Proxima Centauri b, Keplar-186f, TRAPPIST-1 system, Keplar-452b, LHS 1140 b, K2-18b, TOI 700 e, GJ 357 d, Ross 128 b, and Gilese 12b.
Even though man go fit live for one of de exoplanets, de places no attract me. Even sef dem name no fine.
I tink say Mars beta pass just for im name. Amaa, dem talk say, Mars, as e dey now, man no fit live dere. Dem talk say im atmosplere, extreme cold, lack of a protective magnetic field, and de presence of harmful radiation and toxic soil no go let man live dere.
But hope dey, as de temperature dey minus 62 celsius, man fit design human habitats to resist de extreme cold. As for temperature, we go fit survive am. Sebi cities dey on Earth wey dey go through temperature like dis.
Water dey for Mars, although most dey inside ice. When we reach dat bridge we go cross am.
De soil dey good for agriculture. Nutrients wey go make plant grow boku.
De soil dey good for construction without need for additives. De planet get building material supply boku.
But de planet get gravity wey be less 62.5% than Earth. Researchers fit work on dat and dem don discover say de human body dey resilient to de spacelight environment.
One tin wey dey of interest na say Earth and Mars get similar day-night cycle.
I dey tink am well say Mars na beta place!