Lagos baff taya! – Adewale Sobowale

Photo credit: the Cable

E be like joke at first wen rainwater dey pour for Lagos on Wednesday. But before person sabi, de water don boku everywhere.

E reach so stay passenger for moto and dia driver sef com dey for awol as wetin den tink asy na joke don become big tin. Dem no fit enter road sake of de water wey fill major road plus including Third Mainland Bridge.

video credit: TVC

De rain na elele, e be like say mammy water dey vex.

Rainwater boku everywhere for de state, plus including Iyana Oworo, Alapomeji, Ketu-Alapere, Oshodi-Mafoluku, Aboru, Iyana Ipaja, Iyana Iba, Isheri, Idimu, Lasu, Ijegun, Aberqanje, Ikate, Egbeda, Akowonjo, Jakande Estate, Ogba, Okota, Lekki and Ajah.

As pimpim motocar dey full of water, na im people wey dey dem house sef dey comot water wey de rain don put for dem house. 

De people com dey beg gofment make dem take action with alacrity to helep dem. Dem com complain say de rain dey make life taya dem because dem dey suffer inconvenience, hardship, plus including economic loss.

video credit: TV360

De ministry wey dey in charge of environment and water resources com send help to clear the water wey dey Iyana Oworo. De road com dey free from water.

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *