Photo credit: channels
Kill and go don wear de same torosa with people wey no gree for de tax wey de gofment of Kenya put.
De fight wowo for de capital, Nairobi as demonstrators don waka full contri,
Dem no leave de president home town wey be Eldoret.
De kill and go plus including dose wey dey for horse fire tear gas make de crowd disapprat.
Other places wey de protest reach na Nakuru, Eldoret, Kisumu
Kenya people dey vex say den introduce one kain financial bill wey people no like. De protest don start since Tuesday. Na I’m com make gofment comot some of the provisions plus including 16 % tax on bread and 2.5 % tax on motor.
But people wey dey demonstrate don throway spit for up take face collect am dem talk say na complete person dey blind because if person no blind finish na wotpwoto e dey cause. Dem talk say make dem comot de entire bill.
Dis protest dey different because instead of politicians, na de young people dey run am and e dey peaceful generally.
Den dey use social media with de hashtags #OccupyParliament and #RejectFinanceBill2024. Dem dey beg de people make dem no sleep as members of parliament dey debate de bill.
Even sef, young professionals like doctors and lawyers don juin de protest. Dem dey offer services to people wey dey protest.
Even for Eldoret wey be de home areas of de president, street no laugh as protester gather in dia hundreds to shut down de city.