Photo credit: the citizen
News wey reach us talk say INTERPOL wey be police for de whole world don arrest 300 people wey dem suspect say an ogbologbo for criminal activities. Dem waka across five continents before den fit catch de people.
As dem catch dem, na I’m den seize three million dollars and dem don block 770 bank accounts.
De operation which dem call Jackal III, last from April10 to 3 July. Na 21 countries for five continents dem do am. Dem use am for cases of internet jibiti wey dey popular as 419 weypeople for west Africa dey do.
Isaac Oginni, the oga director of dem cunny for ego talk say de 419 for West Africa don plenty reach.
Dem talk say one of de groups na Black Axe wey dey prominent for gbaju e, trafficking in people, drug smuggling and oda criminal activities for Afrika and even throughout world.
Dem tok say Black Axe dey use mugu to open accounts throughout de world. Dem dey investigate dem for over 40 countries for all de crime wey dem tok say dem don do.
De people wey dem suspect for de crime be people wey be from Argentina,Colombia, Nigeria and Nicaragua.
When de De Argentina investigation don reach five years, de police dabaru de Black Axe. Dem seize 1.2 million dollars wey be fake money. Dem arrest 72 people and dem stop about 100 account for bank.