I nefa see dis kain tin before – Adewale Sobowale

Photo credit: pay prop

As I wan comot for house dis morning go do work and chop, I go check my mailbox. I com see one envelope inside. 

I no take am becos why?

Na from ministry of finance e com.

As I no sabi wetin dey inside, fear com grip me so tay I no fit comot de leta. No be say I dey fear for letter bomb o. My spirit -I no know say I get spirit before – no just gree me take am.

I for take am becos as I no take am, my spirit no fit rest. I com dey tink wetin go dey inside so tay I no fit concentrate.

Wen i come back, na de envelope I first go for. But I no gree open am for outside. In fact, I loku door before I comot de envelope. Wen I open am, na one cheque dey inside. De check na for Ontario Taxpayer Rebate.

I don dey use to getting tax rebate from government of Canada. But dis one na new one. I don dey hear am for media, e surprise me to experience am. 

Dem say make you com chop sara, you say day don near, se na water or oyel dem ask you to bring? In no time, I don use my bank app copy copy the cheque. Na so e become money.

No gofment dey perfect, but e go beta if people wey dey gofment get sympathy for human beings. 

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *