Haitians tak say dem kontri dey shock dem for body!

De people of Haiti wey don japa dey talk say de gang violence for dem kontiri dey shook dem for bodi.

Situation for de country don wowo so stay over 1 million people don leave. As den dey call den family wey still dey, den no happy for de information wey den dey get. Den don close airport, to go by water sef too dangerful.

As ground no level and people for home no dey happy, dose wey japa sef dey sad. Dem japa go Brazil, Chile, Mexico and America. Some of dem cross kontri from Tijuana go San Diego and dem don settle for Miami, New York and Boston.

Haitian Bridge Alliance don dey contact immigrants in America and Canada and dem don see say many get family wey dey inside de kontiri wey gang dey fight. For many of dem, dia papa, mama, sister and broda still dey de kontiri. 

Some dey tell dem say dem never chop for two days. Some dey tak say everyting don pafuka.

video credit: NBC News

Na America be de place many of dem dey go. About 151,000 Haitians don reach America airport. Dem apply online for sponsor. Getting to America from Mexico don go down by Haiti people as people dey enter with two year parole to work. People from Haiti only reach 0.02% of 140,000 people wey  den arrest for border in February.

America don dey give Temporary Protected Status to about 150,000 Haitians wey go dey till de condition wey dey Haiti don beta. 

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *