Photo credit: NPR
Krimina people still dey worry Haiti even as police from Kenya come kombain with de one wey dey Haiti,ground no still level.
Dat’s why dem com do joint operation for one area wey dey rough for Port au Prince wey be de capital, na de Prime Minister Garry Conille yarn am.
Im tok for one hosipita for de capita where e go visit three Haitian police wey dey recover afta den get wounded in a face-to-face gun battle for area wey poor people and krimina dey control.
De Prime Minister tok say im dey taya to dey see say dem shoot police officer, e tok say im dey taya to go for where dem dey bury officer wey kpeme,. E kon tok say dem must stop de problem of insecurity.
E no yarn about de operation too much. Even sef, e no take questions. But he call Haitians make dem cooperate with police and share wetin dey go on to assist in crime control.
One woman police officer don kpeme earlier in the day. Dem kill am as she dey go work on Wednesday. Dem find more dan 12 bullet holes for her windshield. Im name na Michelle Nathanielle Megine. E be one of de about 24 officers wey dem don kpeme dis year.