God dey wonderful abi na tenderful!
I tok so because de Ramadan and Lent com overlap each other dis year. And yet, people wey dey do bad go say dem be Christian or Muslim.
Dem fit be any other religion sef or abi free tinker. De koko of de mata be wether dem be good or bad person.
Anyway, sebi fast don jam fast for many people.
People don boku reach 8.2 billion in de world. At least, 2.8 million people no fit get correct chop.
Accommodation nko? So many people dey homeless. Yet, when we get conflict, we go dey destroy house.
Sense dey dat one?
In fact, war and conflict be number one problem of de world. De tin wey dey confuse me be say, people go fight war before dem go come settle am for conference table. But before dem go gree settle am. so many people go don kpai, many go injure, many go run comot. Anywhere war dey, people no go for farm. and if dem no farm, data one be say food no go dey.
I tink e go beta if we fit find way to settle our conflict through non-violent means.
I throway gbosa for people wey dey fast!