One Yoruba highlife tok say dem luck door for landlord pikin.
Na so e be for Kamlesh Kumar wey be Fiji person before im com cancel de tin when e wan become Australia person. E cancel im Fiji citizenship when im dey go Australia in 2003. In October 2021, e com tok say e wan regain Fiji citizenship again. But wetin im hear com shok am like electic as dem refuse am on December 3, 2021.
Dem tok say de reason why dem refuse am be say im no satisfy de minister say im be good person. Dem tok say Australian Police records show asy Kumar don commit 51 offence wey include, tiftif for shop, assault, using wayo to collect money, driving while disqualified, giving lie lie name and address to police.
Citizenship Appeals Tribunal com rule say de minister for immigration dey correct as e no giv am de citizenship even though na FiJi peson.
De tribunal judges tok say na for Kumar to prove say im be beta person and dat say dem born am for Fiji no be de point or say im get elderly and sick mother no be issue.
When Kumar dey apply, im tok say im be person wey dey obey law and im say im never commit crime!