EFCC say Bello na wanted person!

A Nigerian proverb tok say Bello plenty for Ilorin. Dat one mean say if person dey look for pesin wey dem dey call Bello for de town, e go look taya.

Na so e come be for de governor wey dey Kogi state of Nigeria before, Yahaya Bello, who EFCC don declare say den dey find am. Den tok say den dey find am make e come make explanation for court for money wey reach 80.2 billion naira wey dem talk say im launder.

EFCC suppose put am for court on Thursday. Dem con go im house for Abuja. As im see say na EFCC com arrest am, in stay for house and no allow EFCC enter. De EFCC sef no gree comot de gate.

Crowd don gather see wetin go sele. Dem no even care for dem life.

De present governor, Ahmed Usman Ododo, con come de house with security men. E com carry Bello comot as EFCC no fit touch am because em get immunity. But wetin people dey talk be say, se den dey transfer immunity?

EFCC don tok say dem go get soja make dem help dem find Bello wey den don call fugitive.

Even de oga lawyer for gofment of Nigeria, Lateef Fagbemi wey be SAN don warn Bello say as im run comot no go helep am. Im advise am say make im surrender inself to EFCC. Fagbemi say im disappoint for de tin wey dose wey dey power dey do as dem dey hide people wey dey wanted. E warn say make people no disturb security from carrying out dia dury.

Police don tok say dem don withdraw dia officer wey dey do mai guard for Bello. Immigration sef don dey watch Bello in case im wab run comot from Nigeria.

AbdulWahab Muhammed wey be Belo lawyer no gree with say make dem bring im customer come court for Abuja. Im tok say Bello no dey run from court, so im no be fugitive. E com tok say di Abuja court no get right to hear di case.

But de EFCC don put de foto of Bello with notice dat na wanted person and anybody wey find am make dem contact dem!

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *