As I don dey Naija for all my youth, one tin I never dey use to na winter. When e come, I just dey pity masef.
I dey pity masef sake I no dey like deck masef with winter clothes. And if son of man no dress warm, na frostbite person dey look for.
When winter reach, na only place wey dey necessary person fit go. In fact, na dat time I dey miss Naija most.
So, for last Sunday, as sun dey shine, I no carry coat as church dey near where I dey sleep. Even for Monday, de weather still dey merciful. For today, although e rain small, de weather dey warm.
We no dey value something until we lose am. Sun wey we dey take play for Naija, na im com dey scarce for Canada, na wah o!
A beg gimme Naija weather any day.
Before then, make I go look my coffee