Dem don put jara for Naija passport!

Photo credit: travelstart

Nigeria Immigration Service don inrease cost for passport.

De one wey be 42 page don increase from 35,000 naira go 50, 000 naira. But e go dey for five years before e espaya. De one wey be 64 page don increase from 70.000 naira go 100,000 naira, but dat one go reach ten years before e espaya.

But immigration tok say e no consain people wey dey oversea. 

Dem tok say de increment na to support de oga president Bola Tinuba’s “Renewed Hope” agenda which one be to build local content. 

Dem com put koko point why de increment be must to do. 

Dem tok say the new fees na to improve passport standard and quality because dem want make e dey gidigba for de International Civil Aviation Organization (ICAO).

Dem come tok say de material wey dem dey take do passport don cost.

Dem even took say with de increment, passport front officers and biometric centers go boku. Dat one go meke access to immigration facilities easier and with elele people go dey collect dem passport.

Finally, dem tok say de increment go help dem reach complete domestucation of Nigeria passport booklet. 

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *