Day wey police catch me by Adewale Sobowale

Person wey wan get slap for Sokoto, if im dey Lagos, na jejely e go enter night bus go Sokoto go collect im slap.

Wen I be JJC for Canada, e get somtin wey happen wey I no fit forget.

A remember say for dat time, na Henri Bourrassa Boulevard, Montreal I dey live.

People wey sabi Montreal go sabi say de street na busy one. Na one of de busiest. De place be like motor-jam-police.

So, I con comot for house because I wan go buy sometin. Na hurry I dey waka because I dey go work for night.

I come reach one t-junction near where I dey live. De junction sef dey busy. Traffic light dey dia. But as I dey hurry and as we dey do from where I come, I wan do Lagos boy.

You know say Lagos no gree sme-sme. Na im I go cross in between motor car. I no no say de car wey I cross im front na police dey inside am.

De police come park and im comot for im car. Na im e con tell people make dem call me. People wey no dey mind dem business com call me.

As dem call me and I look back com see police, de first tin wey come my mind na to run like hare.

But I come tink am say de police fit get whistle. So, I go meet am. As I go, de first question e ask be say whether I see traffic light. I tell am say I see am.

E com ask say why I no obey am. I come talk say na because I dey hurry.

E come book me for fifty dollars. I come dey beg am. But e no gree.

Wen I read de ticket, e say I fit pay for any bank within 30 days unless I wan.contest am.

Contest?
Whosai!
My people dey talk say if person wey do wrong admit am, im no go tay for kneeling.

Na im I go pay fine o and I come learn say culture dey different. Dat’s why Yoruba talk say na like dis we dey behave for our place, na taboo for anoda place.

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *