Pidgin
Russia don put Zelenskyy on wanted list!
As de war wey dey between Russia and Ukraine dey drag like okro and pesin no know when e go end, Russia don declare Oga Presido for Ukraine, Volodymyr Zedlenskyy, say na wanted pesin. Dis declaration get why. De tin be say De President of Russia, Vladimir Putin tink say de war go be small…
Fiji court don tok say tribunal dey correct!
One Yoruba highlife tok say dem luck door for landlord pikin. Na so e be for Kamlesh Kumar wey be Fiji person before im com cancel de tin when e wan become Australia person. E cancel im Fiji citizenship when im dey go Australia in 2003. In October 2021, e com tok say e wan…
My bele dey sweet!
Na so o! Mai bele dey sweet wella. Bikaus why? No be bekaus I chop okporoko and okro with mai gari. No be bekaus I com use tombo top am. I no chop lottery or even baba’jebu. Na jeje I sit don con luk’am for YouTube and I come see say one organization wey dem…
EFCC say Bello na wanted person!
A Nigerian proverb tok say Bello plenty for Ilorin. Dat one mean say if person dey look for pesin wey dem dey call Bello for de town, e go look taya. Na so e come be for de governor wey dey Kogi state of Nigeria before, Yahaya Bello, who EFCC don declare say den dey…
Hunger dey nack 55 million Afrikans!
De world bodi, united Nations Organisation, don tok say about 55 million people dey face hunger for West and Central Afrika. Dem tok say de people go go hunger from June reach August this year. Na de Permanent Inter-State Committee for Drought Control in the Sahel na im report de news. De number de four-million…
No awoof bus for people wey japa again!
“Awoof dey run bele,” na saying for Obodo Naija. BBC report say people say people wey japa to Wales wey be one of the tiri kontiri wey make Great Britain no get awoof for bus again. Dem tok say an de gofment of Wales cancel am. Welcome Ticket wey de gofment start in March 2022…
Haitians tak say dem kontri dey shock dem for body!
De people of Haiti wey don japa dey talk say de gang violence for dem kontiri dey shook dem for bodi. Situation for de country don wowo so stay over 1 million people don leave. As den dey call den family wey still dey, den no happy for de information wey den dey get. Den…


