Boku member of the House of Commons don say make Mr Justin Trudeau no shake as dem dey hin back like hunch. De House do vote of non-confidence vote for Thursday.
De matter be say Conservative Leader Pierre Poilievre tell Mŕ Trudeau say make hin cancel de carbon tax wey e do raise or make kukuma face a vote.
The Conservative Leader tak say den no fit siddon make Trudeau put more sufferhead on Canada people.
Poilievre and hin party don put motion wey hin call gofment to scatter scatter de carbon tax wey den dey plan. De motion fail by 205-119.
Poilievre con say hin go kukuma put a non-confidence motion. Im do am for Thursday morning.
Mr Trudeau still stand gidigba as im win de vote with 204 against 116 wey support de motion.
De tin wey dey surprise people be say Trudeau sef no show face make hin put hin vote against de non-confidence motion. Hin don sabi say hin gofment dey sure. Hin just dey spend hin time dey do meetings and hin vote for remote. Poilievre sef no show face, hin too vote dey Toronto and vote for remote. Hin dey attend fundraiser dere.
De vote go make de country dey talk about de mata. Na dat de Conservatives want.
Polling wey den just do show say 69% Canadians dey bone face for de increase we go happen on April 1. Trudeau don talk am say na dem go get profit from de taxes, still den be like Thomas.