Se na laik dis we go dey go for Naija!

Photo credit: AP News

E get one tin wey dey pain me pass and I go tell readers today.

De last time I check, one of de duties of gofment na to protect Naija people wherever dem dey. 

Amerika oga presido Donald Trump don tok say im go deport plenty Naija people and Naija gofment dey tok say den dey prepare to receive dem. Even de NIDCOM talk person say de commission never hear say dem one deport almost 4,000 people.

Apart from Mexico wey fos refuse to grant de plane deporting migrants right to land, Columbia people know say dem get gofment. De Columbia president no gree make de two planes wey bring migrants land. Trump tink say na joke. E com put 25% tariff for all goods wey dey come from de country. De Columbia president com give Trump baba nla shock as he pay im back double his own coin. 

E impose 50% tariff on all goods wey dey come from US.

No be say Columbia rich pass US, but as Yoruba dey talk, de tin wey we no want as rich person, na as poor person we go dey reject am.

Columbia dey against putting deported people for soja plane and den talk say deportation no mean say make den put people for handcuff and in leg chains like animals. Columbia com do one surprising tin, den send den own air force planes go Amerika to go carry de deportees.

Den president con yarn say den be Columbians with freedom and dignity for their country where den get love.

Dat Oga president Gustavo Petro na real man.

Naija dey wait for Nigerians to be treated without dignity and then go receive dem.

I dey miss Joe Garba and Bolaji Akinyemi as Foreign Ministers. Den sabi de job.o

De one wey dey dere now, I no sabi de name and I no wan know. De only tin be say im do de necessary tin.

Make im do nermal!

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *