Leta to Baba 70! – Adewale Sobowale

Photo credit: NAVI Africa

The Great Angel,
Kalakuta Annex,
Heavenly Kingdom.

Eleniyan,

De first tin na to congratulate you for your new post as The Great Angel.

You know say you really deserve am.

But I dey vex for you o.

You know why?

As you dey heaven dey sing for Baba God an im dey happy, at least e go dey give you more than de allowances wey ordinary ministers for Nigeria dey enjoy.

You know say for here ground no level. Na only de ministers dey enjoy.

Ordinary Abacha wey do us bashabasha dey remember us not to talk of you wey be people’s Prophet.

A beg remember us biko, de tin don pass be careful.

Se you still like dodo and moinmoin? I no fit forget de one wey we chop when we come your house for Ikeja. I beg anything you chop remain make you pass am down o. Abi you wan make all of us die?

I no say you go de flenjor with your Queens, as we dey here body no dey rise because of money. You know say you sing say bread and akara small, but now dem no dey available. Even the mata kon over wowo as petrol don join put.

Na waka I dey waka go work everyday and without food.

I beg make you remember us. You know say we dey talk am say person wey don go heaven no dey forget im shildren.

Make I go queue for fuel with the little shange wey remain for my hand!

080223

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *